Jump to content

Adae Kese Festival

From Wikipedia
Adae Kese Festival
Festival
Ethnic groupAshanti Edit
ContinentAfrica Edit
CountryGhana Edit
Edey de administrative territorial entity insydAshanti Region Edit
Historic countyAshanti Region Edit
Ein locationKumasi, Ashanti Region Edit
Month of the yearJuly, October, January Edit

Adae Kese Festival, wey mean "big resting place", be important but not-too-common celebration among de Ashantis for Ghana. Dem get two main times wey dem dey celebrate am, one be Awukudae, de other one be Akwasidae.[1][2] De festival dey praise de great things de Asante Kingdom do. De first time dem celebrate Adae Kese be wen na de Ashantis get dema own state after de big war wey give dem independence, de Battle of Feyiase, wey dem fight plus de Denkyira[3] people. De festival sanso be de time dem dey do de purification ceremony wey dem dey bell Odwira for de burial places of de ancestral spirits. More times, dis dey happen around de same time as de yam harvest season, so some Europeans dey call am de "Yam custom." De Ashanti people dey celebrate dis festival every two weeks based on de Akan calendar, wey follow de forty-two-day cycle over nine months. De festival mostly dey happen to mark big achievements plus important milestones of de Ashanti Kingdom people. That day be day of rest, so dem no dey allow make anybody work on dat day.[2]

References

[edit | edit source]
  1. WhiteOrange. "Adae Kese Festival". Ghana Tourism Authourity. Archived from the original on 2019-12-26. Retrieved 2019-12-26.
  2. 1 2 "Adae | Akan festival". Encyclopedia Britannica. Retrieved 2020-01-20.
  3. WhiteOrange. "Adae Kese Festival". Ghana Tourism Authourity. Archived from the original on 2019-12-26. Retrieved 2019-12-26

Bibliography

[edit | edit source]
  • Agorsah, E. Kofi (2010). Religion, Ritual and African Tradition: AfricanFoundations. AuthorHouse. pp. 42–43. ISBN 9781449005528. Retrieved 24 November 2012.
  • Roy, Christian (2005). Religion Traditional festivals. 2. M – Z. ABC-CLIO. p. 2. ISBN 9781576070895. Retrieved 24 November 2012.