Jump to content

André Matsoua

From Wikipedia
André Matsoua
human
Ein sex anaa gendermale Edit
Ein country of citizenshipFrench Congo Edit
Name wey dem give amAndré Edit
Ein date of birth17 January 1899 Edit
Date wey edie13 January 1942 Edit
Ein occupationpolitician Edit
Political ideologyQ3614193 Edit

André Grenard Matswa (Matsoua for French; 17 January 1899 – 13 January 1942) be Congolese Lari wey dey fight colonialism, e born for near Manzakala-Kinkala for dat time wey dem dey call Middle Congo,[1] one rare person wey get power for Congolese politics before dem gain independence for 1960. E inspire one messiah culture, wey dem dey call Matswanism or Matsouanism, wey come from Brazzaville de capital for French Equatorial Africa.[2]

Ein Life

[edit | edit source]

Matswa anaa Matsua (for Kikongo) born for 1899 inside small village wey dey Loukoua-Nzoko for French Congo. For 1925, e join Senegalese Tirailleurs plus e take part for de Rif War.[3] Insyde 1926,[2] Matsoua start Amicale des Originaires de l'A.E.F., na group wey dey help people improve dem self, when e dey live for Paris.[4] E dey go events wey French Communist Party sponsor, plus e help build trade unions for black people. Plenty pipo don start to see Matsoua like prophet, wey God send to free the Congolese from de French.[2] As Victor T. Le Vine talk am, Matsoua be like Kimbangu, him be 'martyr for de eyes of him followers' plus e get some kind 'quasi-religious vibe' too.[5]

For December 1929, dem arrest am for Paris make dem carry am go trial for Brazzaville, under di false talk say e dey swindle money from di African Indigenous people for French Congo. Di money wey come from free and voluntry contributions to di Indigenous people sef dem collect am from de colonial administration.[3]

When Matsoua come back Africa for 1930, dem carry am go court for Brazzaville because he dey against colonial rule. On 19 March 1930, Matsoua beg Court of Brazzaville make dem try am as French citizen because of how he take become citizen and dem catch am for French land.[3] Dem Court for Brazzaville jam him with 3 years inside prison, plus dem no go allow am enter French Congo for 10 years.dis matter happen for 2 April 1930.[3] One week later, dem give am ten years exile for Chad, where e escape waka comot from Fort Lamy for 1935 run go France.

For 1940, during World War II, e take wound for front for Lorraine as dem dey fight Germans. Dem carry am go Beaujon Hospital for Paris for treatment. On 3 April 1940, dem catch am for him hospital bed for Paris as dem dey accuse am say e don attack French state security people.[3] Den transfer am go French Congo, dem sentence am make e do forced labor for Brazzaville for February 1941.[2] Dem talk say e dey spread pro-German propaganda for the capital.[5] For 20 February 1941, e land for Mayama prison wey e go spent 11 months for insyde, di guy don chop torture and beatings well well.[3] E die for prison on 13 January 1942.[2]

Legacy

[edit | edit source]

After dem gain independence, some Congolese politicians wey dey get different ideas try chop Matsoua popularity, like President Abbé Fulbert Youlou, Alphonse Massamba-Débat and Denis Sassou-Nguesso, plus insurgent leader Bernard Kolélas. Dem even get statue wey dey honor am for Kinkala.[2]

Bibliography

[edit | edit source]
  • Bruce Mateso, André Grenard Matsoua : Les fondements de l'Amicale, Paari éditeur, 2020.
  • Didier Gondola, Mastwa vivant: Anticolonialisme et citoyenneté en Afrique-Équatoriale Française, Paris, Les Éditions de La Sorbonne, 2021.

References

[edit | edit source]
  1. Derrick, Jonathan (2008). Africa's "agitators" : militant anti-colonialism in Africa and the west, 1918-1939. New York: Columbia University Press. pp. 241. ISBN 9780231700566.
  2. 1 2 3 4 5 6 Clark, John F.; Decalo, Samuel (9 August 2012). Historical Dictionary of Republic of the Congo. Scarecrow Press. p. 29, 274. ISBN 978-0-8108-7989-8.
  3. 1 2 3 4 5 6 "MATSOUA, le Grand Résistant" (in French). Blog Spot. 24 March 2013.
  4. Franz Ansprenger (1989). The dissolution of the colonial empires. Taylor & Francis. p. 103. ISBN 978-0-415-03143-1.
  5. 1 2 Vine, Victor T. Le (2004). Politics in Francophone Africa. Lynne Rienner Publishers. p. 188. ISBN 978-1-58826-249-3.