BXC Solar Power Station
| Country | Ghana |
|---|---|
| Coordinate location | 5°22′22″N 0°41′36″W |

BXC Solar Power Station (dem dey call am Onyandze Solar Power Station) be one solar light farm wey dey produce 20 megawatt power for Ghana. Na Beijing Xiaocheng Company (BXC), one Chinese company wey dey do independent power business, build am, put money insyd, own am wey dem dey run am. Dem commission am for April 2016. Dat time e be de biggest independent solar farm wey fit join national grid for Ghana. De light wey dem generate for der, dem take high voltage cable carry go one substation for Winneba Roundabout, wey e enter de national grid.[1]
Location
[edit | edit source]De power station dey on 100 acres (40 ha), wey dey Gomoa Onyandze, insyd de Gomoa West District, insyd de Central Region of Ghana,wey dey close to de town of Otaw, Ghana.[1] Dis be about 11 kilometres (7 mi), west of Winneba, de nearest large town. Otaw dey approximately 71 kilometres (44 mi) west of Accra, de capital den largest city wey dey Ghana. De geographical coordinates of BXC Solar Power Station be 05°22'22.0"N, 0°41'36.0"W (Latitude: 5.372778; Longitude:-0.693333). De solar farm dey close proximity to de 20 megawatt Gomoa Onyaadze Solar Power Station.[2]
Overview
[edit | edit source]De power station get an installed maximum generation capacity of 20 megawatts, although de owner/developers get plans of expanding generation capacity to 40 megawatts.[1] De energy wey dem generate hie dem dey convey am via a high voltage transmission line from de power station to a substation wey dey belong to Power Distribution Services Ghana (PDSG), wey dem dey call Electricity Company of Ghana (ECG) before, wer de energy take enter de national grid. A long-term power purchase agreement, wey dey between PDSG den de owner/operators of de power station dey govern de terms of sale den purchase of de energy.[3][4]
Ownership
[edit | edit source]De power station be Beijing Xiaocheng Company (BXC) demma own, e be electronics den technology company, wey dey Beijing, China. De parent company get Ghanaian subsidiary, BXC Ghana Limited. De parent give money wey dem for use construct de solar farm. De local subsidiary wey dey operate den dey manage de power station.[4][5]
Challenges
[edit | edit source]Ghana ein renewable energy projects, wey dey include BXC Solar, dey face wahala like ECG no dey pay on time, small chance to get money expand de project, den regulation rules wey dey slow things.[6]
Funding
[edit | edit source]De construction cost reach US$30 million, wey de owner (BXC) take dema own money build am.[1][7]
References
[edit | edit source]- 1 2 3 4 "Ghana's Largest Solar PV Project Just Connected To The Grid". CleanTechnica. 17 April 2016. Retrieved 31 July 2021.
- ↑ "About Gomoa Onyaadze Solar Power Plant". ECOWAS Observatory for Renewable Energy and Energy Efficiency (Ecowrex). September 2018. Retrieved 31 July 2021.
- ↑ Antony Kiganda (25 April 2016). "Newly constructed 20MW power plant in Ghana begins operation". Construction Review Online. Nairobi, Kenya. Retrieved 31 July 2021.
- 1 2 "Chinese tech firm leads Ghana's solar energy breakthrough". China Daily. Beijing, China. 14 April 2016. Retrieved 31 July 2021.
- ↑ "BXC completes 20 MW solar project in Ghana". Photon.Info. Aachen, Germany. 13 July 2016. Retrieved 31 July 2021.
- ↑ "International Renewable Energy Agency". January 2021.
- ↑ "About Onyandze Solar Power Plant (BXC Solar Power Station)". ECOWAS Observatory for Renewable Energy and Energy Efficiency (Ecowrex). Praia, Cape Verde. April 2016. Retrieved 30 July 2021.
External links
[edit | edit source]- Africa Battles to Get Big Solar Projects on Grid As of 4 August 2016.
- Could waves become the next big renewable energy source? As of 3 January 2017.