Jump to content

Condom

From Wikipedia
condom
Subclass ofmale contraceptive, female contraceptive devices Edit
Get usebarrier contraception, safe sex, prevention of sexually transmitted diseases Edit
Facet givewomen's health Edit
Made from materialnatural rubber, latex, polyurethane, synthetic rubber Edit
Subject has roleessential medicine Edit
‎worn onpenis Edit

Condom be like raincoat wey you dey wear for your john thomas or lady yansh top before you do the do, so you no go get belle or catch any STI.[1] Condom dey for man, condom dey for woman too.[2] If dem dey use am well—like every single time dem dey do am—women wey demma guys dey use condom, dem dey get like 2% chance of gettin belle for one year.[1] If you dey use am normal normal, pregnancy fit happen 18 times outta 100 every year. Dem dey use am dey cut down de risk for gonorrhea, chlamydia, trichomoniasis, hepatitis B, plus HIV/AIDS big time.[1] E dey fi protect small against genital herpes, human papillomavirus (HPV), plus syphilis sef..[1]

Man condom, you dey roll am put for top of your prick wey stand proper before you do de do. E dey block am make de man pikin seed no go enter woman insyde.[1][3] Normally dem dey make man kondom from latex, but sometimes dem dey use polyurethane, polyisoprene or even lamb nyama intestine.[1] Man kondom dey easy to use, easy to find, plus e no dey give too much wahala.[1] If you dey allergic to latex, make you use polyurethane or some other synthetic thing instead.[1] Female condom dem dey usually make am from polyurethane, and you fit use am more than once.[3]

Dem dey use Condom prevent STI since 1564 sef.[1] Rubber condoms begin dey available for 1855, den latex condoms come follow for 1920s insyde.[4][5] E dey World Health Organization ein list of important drugs wey everybody suppose get.[6] For developing countries insyde, if you dey buy am for wholesale, ebe like 0.03 to US$0.08 for each one.[7] For America side, condom no dey cost pass US$1.00.[8] For the whole world inside, e no reach even 10% of people wey dey use birth control dey use condom.[9] Rates of condom use dey higher for developed world insyde.[9] For UK side, condom dey number two for how people dey control birth (22%), but for America side, e dey number three (15%).[10][11] Dem dey sell like six to nine billion every year.[12]

References

[edit | edit source]
  1. 1 2 3 4 5 6 7 8 9 Hatcher, Robert Anthony; M.D, Anita L. Nelson (2007). Contraceptive Technology (in English). Ardent Media. pp. 297–311. ISBN 9781597080019. Archived from the original on 2017-09-18.
  2. World Health Organization (2009). Stuart MC, Kouimtzi M, Hill SR (eds.). WHO Model Formulary 2008. World Health Organization. p. 372. hdl:10665/44053. ISBN 9789241547659.
  3. 1 2 Speroff, Leon; Darney, Philip D. (2011). A Clinical Guide for Contraception (in English). Lippincott Williams & Wilkins. pp. 305–307. ISBN 9781608316106. Archived from the original on 2016-11-14.
  4. Allen, Michael J. (2011). The Anthem Anthology of Victorian Sonnets (in English). Anthem Press. p. 51. ISBN 9781843318484.
  5. McKibbin, Ross (2000). Classes and Cultures: England 1918–1951 (in English). Oxford University Press. p. 305. ISBN 9780198208556.
  6. World Health Organization (2019). World Health Organization model list of essential medicines: 21st list 2019. Geneva: World Health Organization. hdl:10665/325771. WHO/MVP/EMP/IAU/2019.06. License: CC BY-NC-SA 3.0 IGO.
  7. "Condoms (Lubricated)". International Medical Products Price Guide. Management Sciences For Health, Inc. Archived from the original on 2 August 2017. Retrieved 2 August 2017.
  8. Shoupe, Donna (2011). Contraception (in English). John Wiley & Sons. p. 15. ISBN 9781444342635. Archived from the original on 2020-07-29. Retrieved 2020-07-30.
  9. 1 2 Chen, Lincoln C.; Amor, Jaime Sepulveda; Segal, Sheldon J. (2012). AIDS and Women's Reproductive Health (in English). Springer Science & Business Media. p. 6. ISBN 9781461533542.
  10. Herring, Jonathan (2014). Medical Law and Ethics (in English). Oxford University Press. p. 271. ISBN 9780198702269.
  11. Daniels, K.; Daugherty, J.; Jones, J.; Mosher, W. (2015). "Current Contraceptive Use and Variation by Selected Characteristics Among Women Aged 15–44: United States, 2011–2013". National Health Statistics Reports (86): 1–14. PMID 26556545.
  12. Hermann, Henry R. (2016). Dominance and Aggression in Humans and Other Animals: The Great Game of Life (in English). Academic Press. ISBN 9780128092958.
[edit | edit source]