Conjunctivitis
| Subclass of | eye disease, disease, conjunctival disease, inflammatory disease, eye symptom |
|---|---|
| Health specialty | ophthalmology |
| Symptoms and signs | red eye, inflammation |
| ICD-9-CM | 372.30, 372.39 |
| ICPC 2 ID | F70 |
| NCI Thesaurus ID | C34504 |
Conjunctivitis wey dem sanso dey call pink eye, na inflammation (swell plas irritation) of de outer layer of de white part of de eye plus de inner surface of de eyelid.[1] E dey make de eye look pinkish or reddish.[2] Person fit feel pain, burning, scratchy feeling, or itching.[2] De eye wey affect fit get plenty tears or e fit “stick close” for morning time.[2] De white part of de eye fit swell too.[2] Itching dey common pass if de cause be allergy.[3] Conjunctivitis fit affect one eye or both eyes.[2]
De most common infectious causes be virus, den bacteria follow.[3] De viral infection fit come plas oda symptoms like common cold.[2] Both viral plus bacterial types dey spread easily from person to person.[2] Allergy to pollen or animal hair sanso be common cause.[3] Diagnosis mostly dey based on de signs plas symptoms.[2] Sometimes dem dey take small sample of de discharge send go lab for culture test.[2]
Prevention partly dey depend on handwashing.[2] Treatment dey depend on wetin cause am.[2] For most viral cases, no specific treatment dey.[3] Plenty bacterial cases too dey clear by demself without treatment, but antibiotics fit shorten de sickness.[2][3] People wey dey wear contact lenses plas those wey get infection from gonorrhea or chlamydia need proper treatment.[3] Allergic cases fit treat plus antihistamines or special eye drops (mast cell inhibitor drops).[3]
About 3 to 6 million people get conjunctivitis every year for United States.[2][3] For adults, viral causes common pass, but for children, bacterial causes common pass.[3] Normally, people dey recover within one or two weeks.[2][3] If person get vision loss, serious pain, sensitivity to light, signs of herpes or if de symptoms no improve after one week, den further diagnosis plas treatment be necessary.[3] Conjunctivitis for newborn babies, wey dem dey call neonatal conjunctivitis, fit need special treatment too.[2]
References
[edit | edit source]- ↑ Richards A, Guzman-Cottrill JA (May 2010). "Conjunctivitis". Pediatrics in Review. 31 (5): 196–208. doi:10.1542/pir.31-5-196. PMID 20435711.
- 1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 12 13 14 15 "Facts About Pink Eye". National Eye Institute. November 2015. Archived from the original on 9 March 2016. Retrieved 8 March 2016.
- 1 2 3 4 5 6 7 8 9 10 11 Azari AA, Barney NP (October 2013). "Conjunctivitis: a systematic review of diagnosis and treatment". JAMA. 310 (16): 1721–9. doi:10.1001/jama.2013.280318. PMC 4049531. PMID 24150468.
External links
[edit | edit source]- "Pink Eye". MedlinePlus. U.S. National Library of Medicine.
- "Metabolomics for Ocular Surface Disease". MSBB Group, Leiden University. 28 February 2021.