Ellen 'Maposholi Molapo
| Ein sex anaa gender | female |
|---|---|
| Ein country of citizenship | Lesotho |
| Name wey dem give am | Ellen |
| Ein occupation | politician |
Ellen 'Maposholi Molapo be Mosotho politician. She be de first woman wey play big role for Lesotho politics, den she be de first female wey enter Parliament when dem appoint am go Senate for 1965.
Biography
[edit | edit source]During de 1950s, Molapo dey live for Newclare area insyd Johannesburg, where she be member for Garment Workers Union den she turn activist for African National Congress.[1][2] After she attend de first conference of de Basutoland Congress Party (BCP),[3] she start dey campaign for de party among Basutoland people wey dey work for Transvaal, den she become de first woman wey enter de party ein leadership.[4] She join Pan Africanist Congress too, den dem elect am as treasurer.[5]
Insyd 1960, she lef BCP after she get wahala plus de party ein leader Ntsu Mokhehle. She plus some PAC leaders dem take dem go court for South Africa for 1961 say dem dey run illegal organisation, den Molapo get twelve-month jail sentence. De next year, South African authorities deport am. After dat, she join Marematlou Freedom Party wey ein brother Seth Matotoko dey lead — dem two live together when she dey South Africa. For campaign rallies, she dey overshadow Matotoko plus ein strong talk den songs, den people see am as one of de party ein most powerful campaigners. Insyd April 1965, dem appoint am go Senate, den she become de first woman wey enter Parliament for de country.[6]
References
[edit | edit source]- ↑ Gail M. Gerhart (1977) From Protest to Challenge a Documentary History of African Politics in South Africa 1882-1964: Challenge and Violence 1953-1964, p372
- ↑ Shanguhyia, Martin S.; Falola, Toyin (2018-01-28). The Palgrave Handbook of African Colonial and Postcolonial History (in English). Springer. ISBN 978-1-137-59426-6.
- ↑ Marc Epprecht (1992) Women, Class and Politics in Colonial Lesotho, 1930-1965, pp345–346
- ↑ Epprecht, Marc (1995). "Women's 'Conservatism' and the Politics of Gender in Late Colonial Lesotho". The Journal of African History. 36 (1): 29–56. ISSN 0021-8537.
- ↑ Suid-Afrikaanse Hofverslae, volume 4, p321
- ↑ Mart Martin (2000) The Almanac of Women and Minorities in World Politics, p229