Jump to content

Ghana National Gas Company

From Wikipedia
Ghana National Gas Company
business
Industrypetroleum industry Edit
Owner beGovernment of Ghana Edit
Demma headquarters locationAccra Edit

Ghana National Gas Company be government company wey dey run all de infrastructure wey dem need make dem gather, process, carry den sell natural gas forGhana.[1]

Ghana Gas dey run like business. Dem dey make money through how dem dey process, carry and sell natural gas plus natural gas liquids. Right now, GNGC dey give gas to Volta River Authority (VRA) make dem take do light for power generation.[1]

History

[edit | edit source]

Government of Ghana form de company for July 2011.[2]

Official production start for November 2014. De company dey specialize for production and exploration of lean gas, condensate, LPG and isopentanes. Dem too dey play key role wey dey push de country ein industrial sector make e grow.[1]

References

[edit | edit source]
  1. 1 2 3 "Ghana Gas Company Limited". SIGA: State Interests and Governance Authority (in American English). Retrieved 2024-11-26.
  2. "Profile | Ghana National Gas Company". GhanaGas. Archived from the original on 2015-04-21. Retrieved 2015-06-30.