Gora Ebrahim
| Ein sex anaa gender | male |
|---|---|
| Ein country of citizenship | South Africa |
| Name wey dem give am | Ahmed |
| Family name | Ebrahim |
| Ein date of birth | 29 May 1936 |
| Date wey edie | 25 November 1999 |
| Ein occupation | politician |
Ahmed Gora Ebrahim (wey dem born 29 May 1936 – die 25 November 1999) be South African politician plus former anti-apartheid activist. During de apartheid time, e be foreign secretary for Pan Africanist Congress (PAC), wey e represent de party for National Assembly from 1994 till 1999. Just small time after e lose ein parliamentary seat insyd June 1999, plus shortly before e die insyd November dat same year, e comot PAC join African National Congress (ANC).
Early life den anti-apartheid activism
[edit | edit source]Dem born Ebrahim on 29 May 1936 insyd Durban wey dey former Natal province.[1] Him and ein younger brother, Ebrahim Ismail, both take part for politics from demma youth time; Ebrahim himself take part insyd Trotskyite circles insyd Natal University plus University of the Witwatersrand. But while ein brother go join ANC,[2][3] Ebrahim join PAC insyd 1957, wey e go exile for 1963 after dem ban de party.
Over de next three decades, Ebrahim be top representative for PAC abroad; different times e serve as de party ein main rep insyd Egypt, Iraq, China, Zimbabwe, plus insyd de United Nations for New York. Insyd 1969, as e dey based for Dar es Salaam inside Tanzania, dem appoint am as PAC ein secretary for foreign affairs. E be part of de people wey start de South African Non Racial Olympic Committee, plus e act as president when dem detain Dennis Brutus. During de five years wey e spend for Iraq, e be editor for de Baghdad Observer. E come return go South Africa for 1990 after apartheid government unban de PAC, plus e follow serve for PAC ein delegation for de negotiations wey end apartheid.[1]
Post-apartheid political career
[edit | edit source]Insyd South Africa ein first post-apartheid elections for 1994, Ebrahim get elected to represent PAC for de National Assembly.[4] After just one term for de assembly, e lose ein seat for de 1999 general election as PAC no perform well. After de election, media reports talk say Ebrahim dey almost leave PAC go join ANC, wey dem say offer am diplomat post;[5] e come defect shortly after.[6]
Personal life den death
[edit | edit source]Ebrahim meet ein French wife, Xaviere, for China, where she dey work as translator. Dem get two children—one boy plus one girl—wey dem born during exile time for Tanzania.[1]
Few months after e join ANC, Ebrahim die on 25 November 1999 for ein house for Berea, Johannesburg, after heart attack catch am.[6]
References
[edit | edit source]- 1 2 3 "Ahmed Gora Ebrahim". South African History Online. 25 October 2013. Retrieved 2023-05-29.
- ↑ Williams, Christopher (2023-01-05). "Beyond Fear: By Ebrahim Ebrahim. Johannesburg: Jacana, 2022. xi + 300 pp. ISBN 978 1 4314 3232 5". South African Historical Journal (in English): 1–3. doi:10.1080/02582473.2022.2157472. ISSN 0258-2473. S2CID 255723457.
- ↑ Orkin, Mark (1992). "'Democracy Knows No Colour': Rationales for Guerrilla Involvement among Black South Africans". Journal of Southern African Studies. 18 (3): 642–669. doi:10.1080/03057079208708330. ISSN 0305-7070. JSTOR 2637303.
- ↑ South Africa: Campaign and Election Report April 26–29, 1994. International Republican Institute. 1994. Retrieved 13 April 2023 – via Yumpu.
- ↑ "PAC leadership erosion begins". The Mail & Guardian (in English). 1999-06-17. Retrieved 2023-05-29.
- 1 2 "Ex-PAC leader Gora Ebrahim dies". Sowetan. 26 November 1999. Retrieved 29 May 2023.
- Pages using ISBN magic links
- CS1 English-language sources (en)
- 1936 births
- 1999 deaths
- Human
- South African people
- Activists wey komot Durban
- Politicians wey komot Durban
- South African politicians of Indian descent
- South African people of Gujarati descent
- Politicians wey komot KwaZulu-Natal
- South African anti-apartheid activists
- Pan Africanist Congress of Azania politicians
- Members of de National Assembly of South Africa 1994–1999