Jump to content

Jacqueline Moudeina

From Wikipedia
Jacqueline Moudeina
human
Ein sex anaa genderfemale Edit
Ein country of citizenshipChad Edit
Name wey dem give amJacqueline Edit
Ein date of birth1957 Edit
Place dem born amChad Edit
Languages edey speak, rep anaa signArabic, French Edit
Ein occupationhuman rights defender, lawyer Edit
Educate forMarien Ngouabi University Edit
Award e receiveRight Livelihood Award, Martin Ennals Award for Human Rights Defenders Edit

Jacqueline Moudeina (born 1957) be Chadian lawyer den human rights activist. People know am well-well for de big work she do to bring Hissène Habré go court for crimes against humanity, plus all de people wey work plus am.

Ein biography

[edit | edit source]

Dem born den raise Jacqueline for Chad; but for 1979 wen civil war bust for de country, she stop ein English studies for de University of Chad wey she run go Congo plus ein husbie. Dem live for der more dan 13 years before dem return. For de time she dey der, she get master's degree for Private Law from de University of Brazzaville.[1]

She return come Chad for 1995, after de "reign of terror" wey happen for de time Hissène Habré be president fini. She register as legal intern, wey she be one of de first women wey do dat for de country. Later dem promote am turn legal secretary, wey by 2004 she come turn de president of de Chadian Association for the Promotion and Defense of Human Rights. For dat ten-year period, she start to gather evidence for all de bad things den atrocities wey Habré den ein people do.[1]

For February 23, 2001, Jacqueline join peaceful protest for front of de French Embassy to talk say de presidential elections no go well. For de protest insyd, de Chief Police Commissioner, Mahamat Wakaye, give order say make dem use force scatter de people. Grenade come hit Jacqueline wey e wound am heavy, so she spend more than one year for France dey treat ein body. Some people wey see wetin happen talk say Wakaye give order say make dem target Jacqueline specifically for de attack.[2]

Habré ein trial

[edit | edit source]

For 1982, Hissène Habré take power thru coup d’état.[3] For 2000, as Habré dey live okay for Senegal, Jacqueline file ein first case against am for seven women demma name. De judge for de case talk say Habré follow do de torture den barbarity, so he charge am. But one year later, de judge dismiss de case say e no dey under Senegalese jurisdiction. Jacqueline den de victims no gree; dem go file de case for Belgium, sake of law dey der wey talk say anybody wey do torture for anywhere for dis world, dem fit catch am den try am for court.

After five years wey dem dey try de matter, de Belgium judge charge Habré for war crimes, crimes against humanity, den genocide. Dem put international arrest warrant for ein head, wey dem ask Senegal make dem release am (extradition). Dem catch am den keep am for ten days, but de Senegalese prosecutor talk say he no get power to follow de request. De Senegalese President talk say de case be "African issue," so he move de matter go de African Union.[4] Finally, for May 30, 2016, dem convict Hissène Habré to life imprisonment for all de crimes he do.[5]

For 2005, de African Union ask Senegal say make dem prosecute Habré for "de name of Africa," sake of dem talk say no African head of state suppose go trial for outside Africa. But after 6 years pass, Senegal announce say dem no go fit do de trial against am. Jacqueline no stop; she start dey find other international ways make dem fit extradite am.[6] Finally, for 2013, one court for Senegal give order say make dem arrest Habré.[7]

References

[edit | edit source]
  1. 1 2 "The Witness: The Challenge of Human Rights in Chad". thewitness.org. Archived from the original on 2010-11-29. Retrieved 2026-03-24.
  2. "Impunity for attack on Human Rights Defender in Chad | Front Line". www.frontlinedefenders.org (in English). Archived from the original on 2011-12-04. Retrieved 2026-03-24.
  3. "Jacqueline Moudeina - Martin Ennals Award Jacqueline Moudeina". Martin Ennals Award (in American English). Retrieved 2026-03-24.
  4. Wegner, Patrick (2011-12-18). "No Limits for Justice? Universal Jurisdiction and the Case of Former Chadian President Hissene Habré". Justice in Conflict (in English). Retrieved 2026-03-24.
  5. "Tchad : que devient Jacqueline Moudeina, l'avocate qui a fait tomber Hissène Habré ?". JeuneAfrique.com (in French). Retrieved 2026-03-24.
  6. "Jacqueline Moudeina: "Impunity is a cancer that prevents us from realizing our true potential"". 2011-07-12. Retrieved 2012-11-01.
  7. Simons, Marlise (2015-07-18). "Surviving Grenade and Terror to Bring Chad's Ex-Leader to Trial". The New York Times (in American English). ISSN 0362-4331. Retrieved 2026-03-29.
[edit | edit source]