Jump to content

Lake Sulunga

From Wikipedia
Lake Sulunga
lake
InflowsBubu Edit
CountryTanzania Edit
Edey de administrative territorial entity insydDodoma Region Edit
Coordinate location6°5′0″S 35°11′0″E Edit
Map
Drainage basin of Lake Sulunga (green)

Lake Sulunga wey people know as Bahi Swamp be one shallow seasonal lake wey dey for border of Dodoma den Singida region for Tanzania. E be de biggest water body for both region during rainy season.

E dey about 45 km west of Dodoma capital inside one endorheic basin wey dem dey call Bahi depression. E dey for altitude of 830 metres (2,720 ft) wey e fit spread reach 974 square kilometres (376 sq mi). De catchment area be 23,447 square kilometres (9,053 sq mi). Di lake dey about 42 kilometres (26 mi) long den 26 kilometres (16 mi) wide, but e fit vanish completely for dry season. De main rivers wey dey feed am be Bubu den Mponde.

De lake be surrounded by plenty settlements wey e dey play big role for local fishing den animal rearing.[1]

But de lake fit get serious wahala for future secof mining fit affect am well‑well. De area get uranium, gold wey e fit even get diamonds.[2]

References

[edit | edit source]
  1. ↑ "Hydrology of the Bahi wetland, Tanzania" (PDF). Archived from the original (PDF) on 2015-12-05. Retrieved 2018-10-01.
  2. ↑ "Bahi North". Archived from the original on 2011-02-24. Retrieved 2020-09-20.