Mombasa Mainland Desalination Plant
| Country | Kenya |
|---|---|
| Coordinate location | 3°57′43″S 39°45′41″E |

Mombasa Mainland Desalination Plant (MMDP), be planned water purification project for Kenya.[1]
Location
[edit | edit source]Dem go build dis water treatment facility for mainland side of seaport city Mombasa for Kenya ein Indian Ocean coast.[1]
Overview
[edit | edit source]Mombasa County no get ein own source of potable water insyd de county. Fresh water wey dem dey use for de county dey cam from neighboring Kwale County, Kilifi County den Taita Taveta County. De amount of water wey dem places fit supply give Mombasa no reach wetin de county need to serve ein growing population, offices den industries. As of December 2018, de daily fresh water wey dem need be 200,000 cubic meters (200,000,000 L), but de existing sources fit supply only 42,000 cubic meters (42,000,000 L).[1][2]
Desalination plants
[edit | edit source]MMDP be one of four desalination plants wey dem plan say dem go build for Mombasa County make e help solve de shortage of fresh water. Almar Water Solutions dey develop MMDP,[1] be Spanish company wey specialize for water solutions, wey dey include infrastructure development, design, financing den operation.[3]
MMDP be de first one wey dem go develop. Dem plan say construction go start for June 2019 den finish by January 2021.[4]
Oda similar developments
[edit | edit source]Oda desalination plants wey still dey pipeline include Mombasa West Desalination Plant, wey go dey de western side of Mombasa mainland. Dem plan make e produce 100,000 cubic meters (100,000,000 L) every day, wey Almar Water Solutions go develop am.[1]
Likoni Major Desalination Plant go dey for Likoni, plus planned capacity of 70,000 cubic meters (70,000,000 L) every day. Almar Water Solutions go develop am.[1]
Likoni Minor Desalination Plant too go dey for Likoni, plus planned capacity of 30,000 cubic meters (30,000,000 L) every day. Aqua Swiss, one Swiss water solutions company, go develop am.[1]
Construction den cost
[edit | edit source]De estimated cost of dis plant plus de three oda desalination plants for de county na KSh16 billion (US$160 million).[1] Almar Water Solutions sign agreement with Mombasa County government say dem go design, finance, build den operate de desalination plant for 25 years after dem commission am.[4]
References
[edit | edit source]- 1 2 3 4 5 6 7 8 Baya, Samuel (11 December 2018). "Swiss, Spanish firms clinch Sh16 billion sea desalination deal". Business Daily Africa. Nairobi. Retrieved 11 December 2018.
- ↑ Beja, Patrick (2 May 2018). "Plan to tap vast ocean water for home use launched". The Standard (Kenya). Nairobi. Retrieved 11 December 2018.
- ↑ Almar Water Solutions (11 December 2018). "About Almar Water Solutions". Madrid, Spain: Almar Water Solutions. Retrieved 11 December 2018.
- 1 2 Pumps Africa (29 May 2018). "Mombasa County to get new desalination plants". Nairobi: Pumps-Africa.com. Retrieved 11 December 2018.
External links
[edit | edit source]- Water Solutions awarded a contract to develop Kenya’s first large-scale desalination plant As at 11 December 2018.