Philip Kgosana
| Ein sex anaa gender | male |
|---|---|
| Ein country of citizenship | South Africa |
| Name wey dem give am | Philip |
| Ein date of birth | 1937 |
| Date wey edie | 20 April 2017 |
| Languages edey speak, rep anaa sign | English |
| Ein occupation | politician, anti-apartheid activist |
| Political party ein member | Pan Africanist Congress of Azania |
Philip Ata Kgosana (Born for place wey now be Makapanstad, North West, South Africa 12 October 1936 – 19 April 2017)[1] be one leader for Pan Africanist Congress (PAC) for South Africa. People know am well for de role wey he play as leader of one big demonstration wey happen when he be just 23 years old on 30 March 1960. For dat day, 30,000 people wey no agree plus de country ein pass laws march from Langa go Cape Town. Dis be one of de biggest anti-apartheid demonstrations wey ever happen insyd Cape Town.[2][3]
Kgosana die from cancer on 19 April 2017.[4] Dem rename one part of de M3 expressway wey enter Cape Town to Philip Kgosana Drive to honour am, as dat road be part of de route wey he take march for 1960. Before, dem dey call am De Waal Drive, after Nicolaas Frederic de Waal, wey be one former Administrator for Cape Province wey start de construction of de road during de early 1900s.[5]
References
[edit | edit source]- ↑ "Former PAC leader Philip Kgosana dies". News24. 20 April 2017.
- ↑ "Philip Ata Kgosana". South African History Online. Retrieved 20 April 2017.
- ↑ Heard, Tony (21 April 2017). "Philip Kgosana: The meaning of his courage today". Daily Maverick. Retrieved 17 October 2017.
- ↑ Moatshe, Rapula (21 April 2017). "PAC mourns death of anti-pass hero Kgosana". IOL.
- ↑ Petersen, Tammy (25 August 2017). "Cape Town's De Waal Drive renamed in honour of Philip Kgosana". news24.