Jump to content

Pwalugu Hydroelectric Power Station

From Wikipedia
Pwalugu Hydroelectric Power Station
hydroelectric power station
Get useenergy production Edit
CountryGhana Edit
Edey de administrative territorial entity insydTalensi District Edit
Coordinate location10°36′2″N 0°19′50″W Edit
OperatorVolta River Authority Edit
Map

Pwalugu Hydroelectric Power Station be one hydro power station wey dem dey build for Ghana, e go get 60 megawatts power. Wen dem finish am, e go join plus de Kurugu Solar Power Station wey dem dey plan build for Kurugu wey go get 50 megawatts(67,000 hp). De two go come form one big hybrid power plant (Pwalugu-Kurugu Hydro-Solar Hybrid Power Plant) wey go get total of 110 megawatts (150,000 hp). Dis one go be de first kind for Ghana.[1]

Location

[edit | edit source]

De power station dey on top White Volta river side, close to one town wey dem dey call Pwalugu, for Talensi District insyd Upper East Region. E dey about 142 kilometers(88 mi), northeast from Tamale,Ghana de capital town den biggest city for Northern Region. From Accra, wey be Ghana ein capital den biggest city, e be like 765 kilometers(475 mi), go north.

Overview

[edit | edit source]

De Pwalugu Multipurpose Dam wey dey power de station get plenti uses. E go (a) create one big reservoir lake wey go cover 350 square kilometers (140 sq mi), (b) provide water give de power station, wey go produce between 16.5 megawatts den 60 megawatts energy, based on how dem release de water from de dam, plus (c) supply water for irrigation project wey cover 25,000 hectares (97 sq mi) wey go benefit like 15,000 farmers wey dey depend on agriculture. De power from dis dam go get support from one planned 50 megawatts solar station for Kurugu, wey be area for East Mamprusi insyd North-East Region, about 90 kilometers (56 mi) southeast from Pwalugu.[1]

Construction costs plus funding

[edit | edit source]

Dem budget de whole infrastructure project around US$993 million. Ghana Parliament approve de budget for March 2020. Dem give de procurement, engineering, plus construction contract to Power China International.[1] Buh some oda correct sources talk say de EPC contractor be Sinohydro.[2]

For June 2020 insyd, Power Construction Corporation of China (PowerChina) start clear de site wey dem do oda pre-construction works for Pwalugu. De money wey dem budget include de cost for building de 50 megawatts solar plant for East Mamprusi. Dem dey expect say by 2024, everything go finish den start dey work commercially.[3]

References

[edit | edit source]
  1. 1 2 3 Jean Marie Takouleu (3 March 2020). "Ghana: Construction of the Pwalugu multipurpose dam will start in April 2020". Afrik21.africa. Retrieved 7 December 2020.
  2. "Construction of Pwalugu multipurpose dam in Ghana to start in April 2020". Construction Review Online. 4 March 2020. Retrieved 7 December 2020.
  3. The Press Radio (25 June 2020). "Pwalugu Multi-Purpose Dam Project: Contractor Begins Site Clearing, Construction of Camp Sites and Access Roads". Modern Ghana. Retrieved 7 December 2020.
[edit | edit source]