Samuel Kwesi Oppong
| Ein sex anaa gender | male |
|---|---|
| Ein country of citizenship | Ghana |
| Name wey dem give am | Samuel |
| Date wey edie | 2002 |
| Languages edey speak, rep anaa sign | English |
| Ein occupation | actor, musician |
Samuel Kwesi Oppong (he die 3rd December, 2001). E die for Korle-Bu Teaching Hospital. E be Ghanaian. Dem san know am as S.K. Oppong. E be Ghanaian citizen. Wey e do acting, e be storyteller, e san play guitar. E start work for 1970s go reach 2001. Everybody know am for Osofo Dadzie, Cantata, Abyssinia, Aku Sika, den Anansekom. Samuel Kwesi Oppong (wey e die 3rd December 2001) wey people know am well for theatre inside as (S.K. Oppong) be Ghanaian actor wey e sabi ein work, e be musician den storyteller. Oppong get ein own style wey e dey barb ein sideburn wey make e different from ein fellow actors dem. Apart from acting, e sabi play guitar well well den e be band leader. E dey music business inside since 1950s. E compose, sing den record plenty hi-life songs when e be professional musician. Na e start SK Oppong Guitar Band wey dem tour di whole country den dem play for some of di famous places dem. Di group make small hit for Ghana music scene from 1959 go on with hi-life songs like "Obaa Kunadu", "Akwankwaa Hiani", "Kyere Me Ade a Meye", den oda ones.[1]
Music den concert party
[edit | edit source]Before Osofo Dadzie make SK Oppong famous, ebe musician big time already. E start ein own band wey dem dey call "SK Oppong Guitar Band" like 1950s so, wey e get some correct musicians inside, time wey "burger highlife" just dey blow for Ghana. Dem drop plenty local songs wey people for Ghana like waaawaaa. Time live band dey do demma thing proper for 80s and 90s, Oppong start "S. K. Oppong Drama Group" wey dem dey follow Nana Kwame Ampadu ein African Brothers Band go tour, dey do comedy and drama for the show. Oppong come blow sake of the woman roles wey e dey play for concert party, stage play wey e mix drama and story inside like pantomime. Later the "S. K. Oppong Drama Group" change ein name go "Osofo Dadzie Drama Group" when dem become the drama group wey dey do things for Ghana ein only TV station that time - GTV.
SK Oppong den Osofo Dadzie
[edit | edit source]You know SK Oppong den Osofo Dadzie dey der. Eii, Oppong do woman woman tin for TV ein top for "S. K. Oppong Drama Group" ein first show wey dem call am "Aku Sika" wey dem do am for "Anansekrom" for 1972 insyd. Nana Kwame Ampadu write the play, e blow proper for the first time wey dem show am. The S.K. Oppong Guitar Band sef dey inside Jatokrom, GTV Concert Party tin wey Nana Bosompra II dey manage. GBC-TV see say drama den stories fit teach, sweet people, den tell them something, so dem talk to S. K. Oppong Drama Group make dem be the house people wey go dey do drama for dem. Then dem change the name go Osofo Dadzie Drama Group so e go show the good things den the lesson for inside the play, cus of Osofo wey dey talk the main point wey everybody suppose learn for the end. The late Nana Bosompra II be the producer, director den the writer for the Osofo Dadzie group, plus Joris Wartenberg dey do the creative director work. Mama Grace Omaboe (Maame Dokono) wey come blow later with Obra, na she be the scriptwriter for the group.
Osofo Dadzie, basically, dem dey turn popular Ghana stories wey people dey tell plus everyday things wey dey happen for inside plays. Oppong be the big man for Osofo Dadzie top for many years after the group take turn be number one. Every Sunday evening, dem dey give millions of people for television enjoyment for 17 years. Oppong play many important roles inside Osofo Dadzie, and most times dem dey give am role wey he be good person wey get good heart. The group ein drama show dem dey do, e be top show for GTV top from 1970 dey go 1990 something inside. Osofo Dadzie ein main aim be say make dem show all the bad things dey happen for Ghana inside, like politricks wayo, favour favour give family and friends, plus bribe. This small way dem dey take tap some big man demma back no sweet some of the government people at all, so dem try do anyhow make the program stop. Osofo Dadzie demma plays dey happen for Akan language inside. The actors dem dey speak Twi, Fante, plus Akuapem mostly. Time ein dey go, the main drama group wey dey challenge dem be Obra. Osofo Dadzie ein plays dey talk 'bout good things like make you dey honest, dey do things right, dey be nice, dey get patience, dey forgive, dey endure, no dey do show, make we come together, and so on. Oppong dey sing for ein drama time, plus sometimes he dey play guitar. Some of ein friends wey dem dey act together inside the group be Nathaniel Frimpong Manso (Osofo Dadzie), Asonaba Kwaku Darko (Super OD), Kwadwo Kwakye, Fred Addai, Kingsley Kofi Kyeremanteng (Ajos), Mercy Offei, Bea Kissi, Jane Ackon (Mama Jane), Akua Boahemaa, Helena Maame Adjoa Pieterson (Adjoa Pee), Louisa Debra (Mama Lee) and others. Oppong take over Kantata Drama Group ein top chair time wey Osofo Dadzie scatter for 1989.
Filmography
[edit | edit source]De list of movie.[2]
- Abyssinia (1985)
- Osofo Dadzie
- Cantata
Discography
[edit | edit source]De list of songs.[3]
- Abusua Bone (Terrible Family) Special
- Okwankwaa Hiani (Miserable Pauper)
- Wo Aba Tenase (Be Rested If You've Come)
- He Hia Wo Mmoa (We Need Your Help)
- Esther
- Besome Daee (Send Me A Dream)
- Otanfo Nya Woa Ͻbeye Wo (The Enemy Seeks to Destroy You)
- Hyia Me Nnɔnson (Meet Me At 7 pm)
- Atea
- Bisa Ma Obi Nkankyrew (Ask To Be Told)
- Anka Me Wo Bi - Maka Ekyi (I Would Have Been Richly Endowed - I'm Left Behind)
- Asaase Nkyiri Fun (The Earth Doesn't Reject The Dead)
- Manhu Woa Mentumi Nda (I Can't Sleep Without Seeing You)
- Wawie Me Ye (You Have Completely Destroyed Me)
References
[edit | edit source]- ↑ "Samuel Kwesi Oppong". GhanaRemembers (in English). Retrieved 2025-08-30.
- ↑ "Government informed about S.K.Oppong's death". 30 November 2001.
- ↑ "S. K. Oppong discography". RateYourMusic. Retrieved 2020-08-11.