Sujud Tilawa
| Subclass of | sujud |
|---|---|
| Part of | salah, Wird, Wazifa |
| Religion anaa worldview | Islam |
| Part of the series | worship in Islam, elements of Salat |
| Main subject | Tilawa |
| Dey follow | Sujud verses |
| Commemorates | God in Islam |
| Physically dey interact plus | soil, prayer rug, Sutrah |
De prostration of recitation (Arabic: سجود التلاوة, sujud tilawa) be prostration (sujud) wey dey occur wen we dey do the ritual Tilawa of Quran inside Salah or outside am.[1][2]
Dem define prostration of recitation (tilawa) sey e be one sujud movement wey person dey do secof e be mustahabb wen de recitation reach one of de verses of prostration inside.[3][4]
Dis Sujud dey happen during Tilawa recitation of de Quran, plus Salah prayers inside Salah al jama’ah.[5]
Muslim jurists agree sey de prostration of recitation be legitimate, plus e be “mustahabb.”.[6]
Fifteen places dey wey Muslims dey believe sey wen Muhammad dey recite some verse (ayah) be, e prostrate to God.[7]
Religious legality
[edit | edit source]Shafi'i den Hanbali jurists dey believe sey prostration of recitation be confirmed Sunnah after de person recite one verse from the verses of prostration inside.[8]
Plus dem base demma opinion for Āyah: 107 for Surat Al-Isra, inside wey God (Allah) Almighty talk sey:[9]
Pidgin: Talk Sey, If you believe am, or you no believe am, truly de people wey dem give knowledge before am, when e dey recite to dem, dem go fall down for sujud for ground inside. Dem narrate some prophetic hadith from de companion Abu Hurairah, make God Almighty dey pleased plus am, wey talk sey:[10] De Messenger of God, peace be upon am, talk sey: “If de son of Adam dey recite ayah wey get de prostration den e come prostrate himself, Satan go left am den cry sey: Charle I loss, dem command de son of Adam sey make e prostrate, den e do am, so hin reward be paradise; wen dem order me to prostrate, secof i no do am, den my penalty be de fire.
Conditions
[edit | edit source]De Muslim jurists talk sey de prostration of Quran recitation get de same conditions wey dey for Salah prayer, like ritual purity, ghusl den wudu or tayammum, facing de direction of qibla, covering de intimate parts in Islam, den avoiding najassa den impurity.[11][12]
Some jurists also talk sey Muslim wey don lose hin two purity, meaning ghusl den wudu, no fit prostrate for Quran recitation inside.[13][14]
If Maliki jurists get reputation say e be permissible make person do prostration for recitation even if ein no get major and minor purity based on Maliki school of thought, still some Malikis dey wey choose make dem no do am without that purity, according to two jurisprudential sayings.[15][16]
Gallery
[edit | edit source]- Unicode symbol of Sujud Tilawa.
- Symbol of Sujud Tilawa.
- Unicode symbol of Sujud Tilawa.
References
[edit | edit source]- ↑ Islamkotob. "الموسوعة الفقهية - ج 24 - زلزلة - سرية".
- ↑ Hussain, Musharraf (10 October 2012). The Five Pillars of Islam: Laying the Foundations of Divine Love and Service to Humanity. Kube Publishing. ISBN 9781847740540.
- ↑ "تيسير الوصول إلى جامع الأصول من حديث الرسول (ص) 1-4 ج3". January 2012.
- ↑ اللباب في شرح الكتاب وهو (شرح مختصر القدوري في الفقه الحنفي). Dar Al Kotob Al Ilmiyah دار الكتب العلمية. January 2016. ISBN 9782745184962.
- ↑ جبرين, عبد الله بن. "فتاوي في سجود التلاوة".
- ↑ "المطلب الثاني: حُكم سُجود التِّلاوة". dorar.net (in Arabic). Retrieved 2024-08-24.
- ↑ تعريف الأقران بأحكام سجود القرآن. Dar Al Kotob Al Ilmiyah دار الكتب العلمية. January 2002. ISBN 9782745135933.
- ↑ إخلاص الناوي في إرشاد الغاوي إلى مسالك الحاوي 1-3 ج1. Dar Al Kotob Al Ilmiyah دار الكتب العلمية. January 2004. ISBN 9782745139757.
- ↑ "The Quran".
- ↑ "تأويلات أهل السنة - تفسير الماتريدي 1-10 ج5". January 2005.
- ↑ السبكي, محمود خطاب (January 2007). "الدين الخالص أو إرشاد الخلق إلى دين الحق 1-4 ج3".
- ↑ "المجموع شرح المهذب 1-27 ج5". January 2011.
- ↑ إرشاد المهتدين في إيضاح بعض المسائل من فروع الدين (مجموعة رسائل فقهية). Dar Al Kotob Al Ilmiyah دار الكتب العلمية. January 2017. ISBN 9782745189080.
- ↑ "الصيام في الاسلام في ضوء الكتاب و السنة".
- ↑ "الخشوع في الصلاة في ضوء الكتاب والسنة".
- ↑ حاشية الميهي الشيبيني على شرح الرملي للستين مسألة من الفروض الواجبة: على شرح الرملي للستين مسألة من الفروض الواجبة على مذهب الامام الشافعي. Dar Al Kotob Al Ilmiyah دار الكتب العلمية. January 2015. ISBN 9782745179388.
