Jump to content

Big Men (film)

From Wikipedia

Big Men be 2014 documentary film wey Rachel Boynton produce and direct. Di film dey look at oil industry, how dem dey develop new oil field for West Africa, di accusations of corruption wey follow, and di resource curse. Di film dey follow Texas-based Kosmos Energy as dem try to start oil production for new Jubilee Field off di coast of Ghana. With plenty money at stake, Kosmos dey manage dem partners for Ghana, financial backers for New York, and di Great Recession wey reduce oil prices sharp sharp. Di film also visit Nigeria's oil-rich Niger Delta, where decades of corruption and lack of development dey fuel militants, wey try to get share of di oil pie. Di film come out on March 14, 2014, to critical acclaim

Production

[edit | edit source]

Di crew film between 2007 and 2011, for Ghana plus Nigeria.[1]

Reception

[edit | edit source]

Big Men receive praise from critics. E get 90/100 on Metacritic plus 100% rating for Rotten Tomatoes.For New York Times, Jeannette Catsoulis write say "dis cool and sharp picture of how global capitalism dey work be as amazing for di access dem get as for di fact say dem no dey judge".[2][3] Alan Scherstuhl of The Village Voice talk say di film "no be simple talk against people wey dey chop money without do anything, like tick wey dey suck blood from person wey no get food", but e be "picture wey show everything clear clear".[4] [5]

References

[edit | edit source]
  1. http://bigmenthemovie.com/
  2. https://www.rottentomatoes.com/m/big_men_2013/
  3. https://www.nytimes.com/2014/03/14/movies/big-men-looks-at-ghanaian-oil-discovery.html?&_r=0
  4. https://www.nytimes.com/2014/03/14/movies/big-men-looks-at-ghanaian-oil-discovery.html?&_r=0
  5. https://www.washingtonpost.com/goingoutguide/movies/big-men-movie-review-pandoras-box-filled-with-black-gold-in-africa/2014/03/26/ecdf71ec-b049-11e3-a49e-76adc9210f19_story.html